← All storiesGeneralDeveloping story Dangote fuel price increase: How US-Israel war wit Iran dey affect fuel prices for Nigeria - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Olukayode Jaiyeola/NurPhoto via Getty Images Some places for Lagos and oda parts of Nigeria don begin dey experience long queues for petrol station and also increase in fuel prices. Car owners, drivers and passengers don begin dey panic ova wetin dem describe as sudden increase in fuel prices and scarcity wey also don dey get effect ontop transport fare. Dangote Petroleum Refinery wey dey for Nigeria tok say na di conflict wey dey happun for di Middle East lead to di shutdown of some refineries and na why petrol product come dey scarce. E say di conflict don lead to cut in refinery production across di world. "Dis dey lead to global scarcity of petroleum products. Di conflict don drive global crude and freight prices sharply higher, wit benchmark Brent prices rising by about 26% within short period to above $84.0 per barrel," Dangote tok. Di BBC News Pidgin witness some petrol queues for Lagos on Friday evening, for places like Berger, Ikeja, and congested areas for Mainland as drivers lament increase in price. One commercial driver say e buy one litre of fuel for ova 1,000 wey no be so bifor and even di struggle to take get di fuel affect im daily work. Dan

Mar 18, 2026
latest update
Mar 7, 2026 → Mar 18, 2026
KEY PEOPLE, ORGS & TOPICS