← All storiesGeneralDeveloping story US-Israel Iran war updates: Irainian President Masoud Pezeshkian apologize for attack on neighbouring countries, Dubai A
Wia dis foto come from, IRANIAN PRESIDENCY / HANDOUT via Getty Images Di President of Iran Masoud Pezeshkian don apologise to dia neighbours say dem no get intention to attack dem. President Pezeshkian declare for im broadcast video message for Iranian state television say Iran go stop dia attacks, unless any kontri attack dem first. Di Iranian President call for regional cooperation to "establish peace and calm" and dem no "intend to invade neighbouring kontris." "I see am necessary to apologise to neighbouring kontris wey dey chop attack," e tok. E say Iran go kontinu to dey resist, but di leadership don also cut warning give di armed forces say make dem no attack neighbouring kontris. "From now on, no attack neighbouring kontris unless dem attack first." "Dos wey dey consider to use dis moment to attack Iran no suppose become puppets of imperialism." Dis na part of di latest on top di conflict wey dey go on behind di US-Isreal and Iran. Meanwhile, di BBC don verify footage wey show drone striking near Dubai International airport. Video wey don spread on social media show explosion and thick smoke above close to di terminal. For di footage, we hear one man dey describe "anoda dro

Mar 7, 2026 → Mar 8, 2026
KEY PEOPLE, ORGS & TOPICS